Wia dis foto come from, @officialbblessingceo/Instagram
Read am in 7 mins
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don drag popular Nigerian social media influencer Blessing Okoro aka Blessing CEO go court again ontop accuse of 13 million naira ($9,551) fraud.
Dis latest accuse dey come a day afta di Nigeria anti-corruption police bin drag her go court on top one 69.1 million naira fraud and anoda 36million naira rental fraud.
Dis new charges border ontop accuse say she collect money by false pretence wey amount to 13million naira.
According to di anti-corruption police, na di Nigeria Cancer Society and some individuals wey di commission no name file dis fresh petition against her.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use…
Never click on links in SMS messages or emails that claim your account has been “suspended” or that you have a “pending package,” as these are classic entry points for credential-harvesting malware.
